NEWS
Burna Boy in Hot Water: Burna Boy panicked after his Diddy tape l3ak3d on Twitter. READ MORE:
Nigerian singer and songwriter, Burna Boy say im be di best for Nigeria music industry.
For tweet wey im share on Tuesday , e say after Afro beat legend, Fela Anikulapo Kuti, na im be di best musician for di kontri. Dem born Damini Ebunoluwa Ogulu for July 2 1991 for Port Harcourt, Rivers State Nigeria.
Pipo begin hear Burna music for 2013 afta im release “Like to party”, di lead single inside im album wey im tittle L.I.F.E since then, im don release Four studio Albums.
For 2019, Burna na one of di artiste wey dem pick from Nigeria, to go represent West Africa to perform for Coachella Valley Music and Arts festival. Di music festival be one of di biggest festivals for di whole world.
For di same year Im record “Ja Ara E” wey e mean “wise up” or you fit call am “use your head”) for Beyoncé’s Di Lion King: Di Gift and na im be di only guest artist with their own track on di soundtrack album.
For July 2019, dem announce Burna as Apple Music Up Next artist.
Im don do collaboration with plenti ogbonge artiste inside and outside Nigeria since im begin dey popular for 2012.